“So di Oga wey bi Israel God don choose mi and my shidren-shidren as king for Israel forever. E sey make Judah tribe dey bring doz wey go lead and na from Judah, E from choose my papa family. And from di family, E kon choose mi as king for Israel.
God tell Samuel, “Na how long yu won to dey sorry for Saul? I don rijet am as Israel king. So put olive oil for yor horn make yu dey go. I dey send yu go meet Jesse for Betlehem, bikos I don choose my king from among en sons.”