God really attack di pipol wey dey stay Ashdod and E kause betta wahala for dem. God put sore for all di pipol body, both doz wey dey Ashdod and doz wey dey stay near der.
Dem kon ask, “Na wetin bi di ofrin wey wi go karry follow am?” Di priest and doz wey dey si vishon kon ansa, “Una leaders na five. So make una karry five gold sore and five gold rat, bikos na di same sickness do una with una leaders.
As Samuel dey burn di ofrin, Filistia pipol dey kom fight Israel pipol. But for dat day, God kon send tonda from heaven go meet Filistia pipol. E make dem fear well-well and Israel pipol kon kill dem well-well.