Dis go bi like sign wey una put for una hand and fore head, so dat Oga God law go dey una mout, bikos na with en strong hand E take karry una komot Egypt.
Wi tell yu for Egypt sey, ‘Make yu leave us as wi dey serve Egypt pipol! E for betta sey wi dey serve Egypt pipol, dan to kom die inside dis wildaness o-o!’ ”
Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.
Yu use yor mighty pawa and great strent take do mirakles and wonders wey make fear katch awa enemies. Na like dis Yu take bring yor pipol, Israel kom back from Egypt land.