Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 78:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

35 Den dem remember sey na God bi dia rock; sey na di Most High God save dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 78:35
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But si as dem kwik forget wetin God do! Dem nor gri listin to en advise!


Dem forget God, dia Savior wey do many great tins for Egypt


Make Yu remember sey na wi bi di pipol wey Yu choose since Yu kreate di world; di tribe wey Yu take as yor own! Make Yu still remember Jerusalem where Yu dey stay.


Dem forget wetin E don do, di great wonders wey E show dem,


Dem nor remember en pawa and how E save dem from dia enemies.


So evry generashon go get hope and trust God and dem nor go forget en great mirakles, but dem go obey en kommand.


With yor true love, Yu go lead di pipol wey Yu save and with yor pawa, Yu go show dem di way to yor holy land.


“So tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi Oga God and I go remove di load wey Egypt pipol put for dia head and dem nor go bi slave again. Na my pawa I go take save una and I go ponish Egypt pipol.


God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish, make una nor fear, bikos I go help una. Mi wey bi Israel God wey dey holy, na mi bi di only Pesin wey go save una.


God wey dey rule and protet Israel pipol; di Pesin wey get pawa sey, “Na mi bi di First and di Last; e nor get any oda god apart from mi wey bi di Almighty God.


God wey save una, di Pesin wey dey holy for Israel, dis na wetin E tok: ‘Na mi bi di Oga una God, di Pesin wey dey tish una wetin dey good. Di One wey dey show una di road wey una go follow.


Make una remember sey una bi slave for Egypt until di Oga una God kon save una! Na dis make mi dey give una dis kommand.


But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.


Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.


But na bikos God love una and dey keep di promise wey E make with una grand-grand papa. Na dis make God save una with en strong hand wen una dey serve as slave for King Fero hand for Egypt.


I pray to am, “My Oga God, make Yu nor distroy yor pipol wey bi yor betta propaty; pipol wey Yu save with yor own pawa kon take dem komot from Egypt with yor strent.


E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ