32 But even as all dis tins dey happen, di pipol still dey sin. With all dis mirakles, dem nor gri trust am.
Dem forget wetin E don do, di great wonders wey E show dem,
bikos dem nor gri bilive God or trust sey E go kare for dem.
“But even as dem dey wildaness, dem rijet mi. Dem break my laws kon rijet my kommand wey dey give life to doz wey dey obey am. Dem distroy di Sabat finish. Wen dem dey di wildaness, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish.
“Abraham ansa am, ‘If dem nor gri listin to Moses and di profets, dem nor go still listin, even if pesin wey don die go back go meet dem.’ ”
Aldo Jesus don do many mirakle for dia front, dem nor still bilive am.