Den God send breeze wey karry one kind bird wey dem dey koll kwail from di sea kom and dem fall kon high rish three fit for di groun. Dem dey evriwhere for di kamp, even for far-far place and for evry direcshon.
So for dat day, for nite and di next day, di pipol kon dey gada di bird. Nobody gada less dan 1,000 kilogram. Dem spread dem round di kamp, so dat dem go dry.