and dat ofisas bin ansa sey, “E nor fit happen, even if God ensef go send korn kom naw-naw!” And Elisha tell am, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from di food.”
One of di king ofisas ansa, “Abeg. Dat nor fit happen! Even if God ensef dey drop food from heaven, e nor go fit happen!” Elisha ansa, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from am!”
I go let grass grow for evriwhere and I nor go trim di vine or use hoe dig di groun again, instead, I go let dirty kover am and rain nor go ever fall put again.”
“Make una bring one out of evry ten tins wey una get kom my temple, so dat food go dey der. Den make una try mi, weda I nor go open heaven kon pour many-many blessings for una head.