Na Samaria bi Israel main town and na King Pekah dey rule am. So if yu nor gri bilive or trust and put yor hope for God hand, den yu nor go fit stand and yu go really die.”
Nobody fit make belle sweet God without faith, bikos anybody wey dey kom meet am, must bilive sey, E dey alive and E dey reward pipol wey dey find am si.
(Di pesin wey bilive God Pikin, go know inside ensef sey, dis tin na true, but pesin wey nor bilive God, dey sey God dey lie, bikos e nor bilive wetin God tok about en Pikin).