13 For der, E divide di sea kon take dem pass as di wota stand up like wall!
I dey shame well-well and na so-so sick I dey sick.
E turn di Red Sea to dry land and en pipol kon dey happy as dem dey waka pass di dry groun.
So Moses stresh en hand face di sea and God kon divide di sea with strong breeze for nite, den di wota turn to dry land.
So Israel pipol waka pass di sea for dry groun; di wota kon form wall for dia rite and left side.
But Israel pipol waka pass di sea for dry groun and di wota form wall for dem, both for dia rite and left side.
Yu breath from yor nose and di wota kon full. Di river wey dey flow kon stand like wall and di part wey deep pass for di sea, kon strong.
Where God wey do great tins thru Moses wey divide di sea kon lead en pipol pass di deep wota, so dat honor and glory wey nor dey end, go bi en own?”
Dia leg strong for groun like horse wey dey run fast and dem nor fall, bikos God dey lead dem.
Yu mash di sea with yor horse and di mighty river kon dey foam.
Di priests wey karry God wey dey rule di whole world Kovenant Box, as dia leg tosh di wota for Jordan River, dat place go divide for una.”
di wota wey dey rush, just stop. E gada go up for one town wey dem dey koll Adam (Adam dey near Zaretan) and no wota rush kom from der again go rish Arabah Sea (Di Salt Sea). Di pipol cross di river wey face Jeriko.