7 So God don rijet mi forever? E nor go ever show mi en love again?
Even doh dem dey shake, dem nor go ever fall, bikos God hold dem with en hand.
Make yu offa sakrifice with di rite spirit give God kon trust am.
But naw, Yu don rijet and disgrace us. Yu nor dey follow awa sojas go fight again.
My God, wetin make Yu rijet us forever? Wetin make Yu dey vex for yor own sheep wey dey yor field?
My God, na how long Yu go dey vex with us? Na forever? Na how long yor vexnashon go dey burn like fire?
My God, Yu don pour blessing and favor put for yor land and give Israel en glory back.
Abi Yu go dey vex for us forever? Yu go just dey vex even for awa shidren-shidren?
But naw, God, Yu don rijet and porshu David shidren-shidren. Yu dey vex with di king wey Yu anoint.
So, my God, na how long dis tins go happen? Yu go hide yor face forever, abi Yu go just dey vex like dat?