Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 77:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Dem hear yor vois like tonda from di strong wind, di lite make di world dey shine and di world kon dey shake with fear.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 77:18
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Oga God dey bring tonda from di sky and evritin dey hear wen God wey get pawa dey tok.


Den di eart bigin shake dey fear, di sky foundashon bigin shake too, bikos God bin dey vex!


Wen Yu kommand, wota dey vanish and wen Yu shaut, e dey bi like tonda and di wota dey kwik-kwik rush komot.


E shot en arrow kon skata en enemies and as en lite flash, dem kon dey konfuse more-more.


Den as God kommand and as E just breath, di sea bottom open and di eart foundashon kon dey show.


Fear kon make di pipol for di eart dey shake. Di mountins foundashon kon dey shake too; dem dey shake bikos God dey vex.


En tonda lite dey shine round di eart, so wen di eart si am, e kon dey shake.


For morning for di third day, tonda, lite and one tick kloud kon appear on-top di mountin, so dem blow di horn well-well. Fear katch all di pipol for di kamp.


Smoke kover Mount Sinai, bikos God land on-top di mountin with fire. Di smoke dey go up like oven own and di mountin kon dey shake well-well.


E dey shine like sun as E dey kom and lite dey shine from en hand, where en pawa der.


At wons, di temple kotton tear from up go rish bottom. Di groun bigin shake and rocks kon skata for evriwhere.


At wons, strong eartkweke happen, bikos God angel kom down from heaven, roll di stone komot kon sidan on-top am.


Den for heaven, God Temple kon open and en Kovenant Box dey inside di temple. Tonda kon dey make nois and spark, den strong eartkweke happen and big-big ice-blok kon dey fall.


Afta all dis tins, I still si anoda angel wey get betta authority, dey kom down from heaven and di way e brite rish, kon make di eart dey shine.


Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.


My God, wen Yu komot from Seir go Edom, di eart shake and rain start to fall from di sky;


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ