Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 77:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Na Yu bi God wey dey do great wonders! Yu dey show yor great pawa among di nashons.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 77:14
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make wi remember all di wonderful tins wey E do; en mirakles and laws wey E give


But God still save dem, just to defend di honor for en name and to show en mighty pawa.


Na-im bi di Pesin wey dey do wonderful tins wey dey sopraiz pipol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.


Pipol wey dey sing, dey waka for en front; while di odas dey play dia instrument dey follow for back and yong girls dey play dia sheke-sheke.


Make una praiz di Oga wey bi Israel pipol God bikos of di wonderful tins wey E do and na only en fit do dem.


bikos Yu big well-well and dey do wonderful tins. Na only Yu bi God,


“Wen una son ask una for future sey, ‘Wetin dis tin mean?’ Una go ansa, ‘Na with mighty pawa God take komot us from Egypt where wi for bi slaves.


My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?


My Oga God, yor rite hand get betta pawa and e skata di enemies to pieces.


Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.


God go use en holy pawa take save en pipol and di whole world go si am.


Naw, I dey kommand sey evribody for dis land wey go tok anytin against Shadrak, Meshak and Abednego God, dem go kut am, just as dem dey kut leaf kon distroy en house.”


E dey perform mirakle and wonders for heaven and for dis eart, E dey diliver and save pipol well-well. E don save Daniel from lions mout.”


Dem dey sing Moses wey bi God savant and di Lamb song sey: “God wey dey mighty, si as di tins wey yu dey do dey big and wonderful! Yu wey bi king for all nashons. Yu nor dey do parsha and evritin wey yu dey do, na true.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ