11 But my Oga God, I remember evritin wey Yu don do. I remember all di wonderful tins wey Yu do before.
As evening dey rish, Isaak kon go di field go relax. Den e look kon si sey some kamel dey kom.
Make una remember all di mirakles wey E do, en wonderful works and di way E take dey judge,
Make wi remember all di wonderful tins wey E do; en mirakles and laws wey E give
E dey make us remember en wonderful works, bikos awa God dey good and dey show mesi!
I remember before-before as I dey tink about all yor great works and doz tins wey Yu don do.
Dem nor kare about di tins wey God do or wetin God make with en own hand. So, God go skata dem finish and dem go disappear forever!
So I kon sey, “Na mi kause am! Na mi let God turn en hand against mi”
Dem forget wetin E don do, di great wonders wey E show dem,
My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?
Yes! Una dey play harp, tamborin, flute and dey drink wine for una party, but una nor undastand wetin God dey do,