1 I shaut and kry to my God; yes I shaut and E hear mi!
From Jedutun sons: Gedalaya, Zeri, Jeshaaya, Shimei, Hashabaya and Mattitaya. Dia papa wey dey profesai wen dem dey praiz God, na-im dey lead dem.
Na dia papa dey lead dem and dem dey sing for God Temple, dey play cymbal and oda instrument as dem dey serve for der. But na di king dey supavise Asaf, Jedutun and Heman.
Wen I kry to God for help, E ansa mi from en holy hill.
I pray to God as I dey sofa and E ansa mi; E save mi from evritin wey dey worry mi.
I tell mysef sey, “I go dey kareful for wetin I dey do and I nor go sin with wetin I dey tok. I go hold my tongue wen sinnas dey near mi.”
Di Almighty One wey bi God don tok; E don gada evribody rite from where di sun for dey raiz go rish where e for dey go down.
I dey kwayet dey wait, bikos na God dey diliver mi.