Trobol gada round mi and I nor fit kount dem! My sins don many well-well and I nor sure sey I go fit dey free from dem! Dem many pass di hair wey dey my head and I don lost all my hope.
Oga, na Yu bi my God and e don tey wen I dey wait for Yu, bikos my soul dey hongry for Yu. My whole body dey hongry for Yu inside dis dry and pash-pash land wey nor get wota.