6 God dey find place put pipol wey don run komot from dia house bikos of war, E dey free prisonas kon make dem prosper. But pipol wey dey sin, dey stay for desert forever.
But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause. Yu dey si evritin; so make Yu ponish dem. Doz wey nor get help dey trust Yu and na Yu dey fight for shidren wey nor get papa and mama.
God wey dey mighty, en Spirit dey on mi, bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol; heal doz wey dia heart break; announce make dem release doz wey bi slave and free doz wey dey for prison.
If e nor gri stop, I go naked am, just as e bi wen dem born am. I go make am bi like dry land, where nor-tin dey grow and I go let wota hongry am till e die.
At wons, di groun start to shake, sotey all di wall and pilas wey dey di prison kon dey shake too. Na wons di door open and di shains wey dem take hook di pipol wey dey di prison, kon luz.
Bikos dem rite am sey: “Woman! Yu wey neva born, make yu shaut dey happy, bikos yu neva labor like woman wey won born. Di woman wey neva born, get plenty shidren pass di woman wey get husband.”
Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear.
Pipol wey dey chop well and get evritin before, don dey fine work naw, so dat dem go si food chop, while doz wey dey hongry before, don si plenty food chop. Even di woman wey neva get belle before, don born seven shidren, but di ones wey get plenty shidren, nor get again.