Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 68:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Na en bi papa to di pipol wey nor get papa and na en bi husband to wimen wey dia husband don die. God dey rule from en holy place.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 68:5
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di priest and Levi pipol stand up kon bless di pipol and God ansa dia prayers from en throne for heaven.


But naw my Oga God, I don build big temple for Yu; place where Yu go stay forever!”


But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause. Yu dey si evritin; so make Yu ponish dem. Doz wey nor get help dey trust Yu and na Yu dey fight for shidren wey nor get papa and mama.


Yu go judge well for shidren wey nor get papa and mama and doz wey dem dey opress, so dat wiked pipol nor go ever treaten dem again.


Di gate wey raitious pipol dey pass enter, make Yu open am for mi, so dat I go-go inside go tank God.


God dey guide di strenjas among us. E dey kare for pipol wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, but E dey ponish wiked pipol with dia wiked plans.


Make evritin wey dey alive, sing praiz God. Make evribody praiz God!


Evritin wey dey alive for dis eart, God dey look dem from en throne.


Den e go judge yor pipol and doz wey dem dey opress, well.


E go defend doz wey dem dey opress among di pipol, diliver poor pipol shidren and distroy doz wey dey opress pipol.


God still tell Moses, “Yu must tell Israel pipol sey, ‘God wey bi una grand-grand papa God; di Pesin wey bi Abraham, Isaak and Jakob God, na-im send mi kom meet una.’ Dis na my name forever and dis na wetin pipol go take remember mi from one generashon go rish anoda.


Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends; dem dey always kollect bribe from pipol. If pipol wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die bring dia kase kom meet una, una nor dey defend or listin to dem.


For dat time, yu go sey: “Make wi tank God! Make wi praiz en name! Make wi tell evribody about di tins wey E do! Make wi tell dem how God big and strong rish.


Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.


God sey, “Heaven na my throne and na di eart I dey put my leg. Wish kind house una go fit build for mi? Wish kind place I go stay?


Shidren wey nor get papa and mama, make yu leave dem for mi and I go kare for dem. Wimen wey nor get husband, make dem make dem kom meet mi and I go help dem.”


Dem don fat and dey chop betta food. Dem nor know wen to stop all di bad tins wey dem dey do. Dem nor dey give doz wey nor get papa dia rite or give betta judgement to doz wey dem dey opress.


Assyria pipol nor go fit save us and awa shariot nor go fit protet us. Wi nor go ever tell juju again sey, ‘Na yu bi awa god!’ Na Yu God dey save doz wey nor get papa and mama again.”


So, make una dey bihave like shidren wey God love well-well.


Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear.


Naw, make Yu look down from yor holy house for heaven kon bless Israel wey bi yor pipol and di land wey Yu promise awa grand-grand papa sey, Yu go give us. Di land wey full with milk and honey.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ