Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 68:33 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

33 bikos na en bi di Pesin wey dey di sky from one generashon go rish anoda! Si! Na-im dey make dat loud tonda nois.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 68:33
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My Oga God nor dey really stay dis eart! If evriwhere for di sky and di heavens wey high pass nor fit kontain Yu, den how dis temple wey I build go bi to Yu?


Na wen di world just start, Yu build di foundashon for di eart kon make di heavens with yor hand.


Yu build yor palis kon put am on-top di kloud where rain from dey kom. Yu turn di kloud to yor shariot kon dey ride am on-top di wind.


E sidan on-top angel feada kon fly go; E fly go with strong breeze.


Nashons don skata and dia kingdoms dey fall! God shaut like tonda and di eart kon bigin melt!


Make di whole eart shaut with joy as dem dey praiz God!


Make una sing about di glory wey en name dey bring! Make una tell di world how en glory big rish.


So, make una sing to God! Make una sing praiz en name! Make una praiz di Pesin wey dey ride on-top kloud! Na God bi en name! Make una happy for en present!


My God, yor throne don dey even before Yu kreate di world. Yu yorsef, don dey forever and ever.


Pipol wey dey outside di kourtyard dey hear di nois wey di creatures feada dey make and e bi like sey na Oga God dey tok.


Di heavens, di heavens wey high pass, plus di eart and evritin wey dey inside am, na God get all of dem.


Israel pipol, no god bi like una God. E dey kom help una from heaven and di sky with en wonderful pawa.


Den one loud vois from heaven go tell di two profet, “Make una kom up!” And dem go-go heaven inside kloud as dia enemies go dey look dem.


Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”


Den for heaven, God Temple kon open and en Kovenant Box dey inside di temple. Tonda kon dey make nois and spark, den strong eartkweke happen and big-big ice-blok kon dey fall.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ