Na mi get Gilead and Manasseh! Efraim wey I dey wear like helmet for head, go produce strong sojas and Judah wey I dey wear for body like war klot, go produce kings.
Jakob shidren-shidren, make una listin to mi. Una wey bi Israel pipol wey kom from Judah tribe: pipol wey swear with God name sey, “Na Israel God wi dey woship,” but una nor mean wetin una dey tok.
Saul ansa, “Na Benjamin tribe wey small pass for Israel, I from kom and na my family small pass for Benjamin tribe, wetin kon make yu dey tok to mi like dis?”