23 so dat una go waka on-top dia blood and una dogs go chop una enemies dead body.”
Make yu tell am, ‘Mi wey bi God sey, “Afta yu don kill pesin finish, yu won still take en propaty too?” ’ Still tell am sey, ‘Na for where dog for lick Nabot blood, na der too, dogs go for lick yor own blood!’ ”
Just as God sey e go happen, dem wosh di shariot for Samaria pool where ashawo for dey baf, den dogs kon dey lick Ahab blood.
Pipol wey dey fear God go happy wen dem si wiked pipol dey fall. Dem go use wiked pipol blood take wosh dia legs.
If dem hide on-top Mount Karmel, I go find and katch dem. If dem hide for bottom sea, I go kommand di wiked animals for sea make e bite dem die.