But Yu, my Oga God! Yu go send wiked pipol go di pit where distroshon dey. Doz wey dey kill pipol and doz wey dey lie, go kwik die, but as for mi, I go trust di Oga, wey bi my God.
God klimb go where high well-well. E don katch and put many pipol for prison. Even men wey sin well-well dey praiz Yu. True-true, di Oga awa God dey stay for der!
Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again.
Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?