Naw, my God, make Yu protet yor pipol with yor shepad stik. Make Yu lead yor pipol wey dey special for yor eye. Even doh dem dey stay alone for bush, make yu let dem chop betta food wey dey Bashan and Gilead, just as dem dey do before.
so en and en men go on-top Mount Zalmon. E take axe for en hand kon kut one branch from one tree. E put am for en shoulder kon tell en men, “Make una kwik-kwik do wetin una si mi dey do!”