7 Yu make di rof sea kwayet kon silent di nashons wey dey kause trobol.
God stop di wave for di sea and evriwhere kon kwayet.
Make Yu nor forget evritin wey yor enemies tok or how dem dey shaut anyhow.
True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu. Yu really dey show as Yu dey vex rish.
Na Yu dey rule di sea and kontrol dia waves.
God na king and en glory wey dey shine well-well, kover evriwhere. True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa. Di world stand gidigba and nor-tin fit shake am.
Na God make di eart with en pawa; na-im wisdom and undastandin E take kreate di heavens and eart.
So dem trow Jonah inside di wota, den di breeze kon stop.
But God send strong breeze go kause wahala for di sea and bikos di breeze strong well-well, di ship won kon break to pieces.
So wen Jesus don tell dem sey, “Na mi bi di pesin”, dem dress go back kon fall for groun.
But Pilate ansa dem, “Wetin I don rite finish, na so e go bi.”
Afta e tok finish, e kon sey make evribody go dia house.