Food go many for di land and seeds go even dey grow well on-top mountins. Make trees bear betta fruit like di trees for Lebanon and make pipol for di land dey grow well like betta grass for di field.
God go pour wota put for di seed wey una plant and di groun go produce plenty food for una. For dat time, una animals go chop betta green grass for field.
Heavens, make una shaut dey happy! All di deep part for dis eart, make una shaut well-well! Make mountins and evry tree for di forest, shaut too, bikos God protet Israel pipol kon show how E great rish.
So heavens make una shaut for joy! Eart, make una shaut dey happy! Make di mountins bigin sing, bikos God go konfort en pipol kon sorry for di ones wey dey sofa.
Una go komot from Babilon with joy and dem go lead una komot from di town with peace. Di mountins and hills go dey sing and di trees go dey shaut with happiness.
Di happiness and joy wey dey Moab land, don vanish. I don make dia wine stop to flow from di winepress. Nobody dey to make wine for dem and una nor go hear happiness nois from der again.