Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 64:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Den evribody go dey fear and dem go tok about di mighty and wonderful tins wey God don do.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 64:9
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I always dey happy to dey learn yor rules and laws.


Make hot shako fall for dia head. Make Yu trow dem for fire or inside pit wey wota dey, where dem nor go fit komot or eskape.


E don give mi new song to sing and hymns wey I go take praiz awa Oga God. Many pipol go si wetin E do kon praiz am, den dem go start to trust God.


Fear go katch dem and na di kind fear wey dem neva si or hear before. God go skata yor enemies bones. God go disgrace dem, bikos E don rijet dem.


Den for di end, evribody go sey, “Yes! Pipol wey dey obey God, go get dia reward. True-true, wi get God wey go judge di whole world!”


Make Yu distroy dem as Yu dey vex! Make Yu distroy dem finish! Den di whole world go know sey God dey reign for Israel.


Yes! Una dey play harp, tamborin, flute and dey drink wine for una party, but una nor undastand wetin God dey do,


(Make una listin! Pipol wey nor get house dey run komot from Babilon go Jerusalem kon tok as di Oga awa God ponish Babilon pipol, bikos of wetin dem do to en temple.)


God sey, “My pipol, make una shaut sey: ‘God don show sey wi dey do di rite tin. So make wi go tell doz wey dey Jerusalem wetin God do for us.’


Yu go si di real rizin why I dey do wetin I dey do.” God wey get pawa don tok.


Make doz wey dey wise, undastand dis tins. Make doz wey get sense, listin well-well. God ways dey true and e dey rite too and pipol wey dey raitious, dey follow am as dem dey live dia life. But doz wey dey sin, go stagga fall.


For dat same time, betta eartkweke go happen and if dem divide di town into ten, one part go distroy finish. 7,000 pipol go die for di eartkweke and evry oda pesin go fear kon bigin tank God wey dey heaven.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ