But Yu, my Oga God! Yu go send wiked pipol go di pit where distroshon dey. Doz wey dey kill pipol and doz wey dey lie, go kwik die, but as for mi, I go trust di Oga, wey bi my God.
Who bi dis wey hold en love dey waka kom from di desert? I wake yu up from under di apple tree where yor mama for born yu. For der, yor mama dey kry with pain, wen e dey born yu.
but yu nor get grave, just like bullet wey dem shot trowey. Yor dead body just dey groun with oda pipol wey dem kill with swod; with pipol wey dem won go trow dia dead body for pit.
Pipol wey don die, dey happy to welkom Babilon king. Pipol wey dey strong well-well wen dem dey life, dia ghost dey wait am and all di former kings ghost raiz from dia throne dey wait am too.
Anybody wey dey porshu and won kill yu, di Oga yor God wey dey heaven go protet yor life and nor-tin go happen to yu. But e go skata and kill yor enemies, wons and for all.