Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 63:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 I hold Yu tait, bikos na yor strong rite hand dey save mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 63:8
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Evritin wey e do to take serve God well for en temple and to follow God laws and kommands, Hezekaya do dem with e whole heart and bikos of dis, God kon make am prosper.


My God, Yu don give mi wetin go protet mi. Yor rite hand dey support mi and I don dey strong, bikos of di way wey Yu dey help mi.


Even doh dem dey shake, dem nor go ever fall, bikos God hold dem with en hand.


Instead, Yu don keep my life, bikos I dey innocent; Yu don let mi enter yor present forever.


Yet, I still bilong to Yu and Yu hold my rite hand.


Na who I get for heaven escept Yu? I wont Yu more dan anytin for dis eart.


But I shaut kon kry sey, “I dey fall” so Oga God wey en love nor dey fail, kom support mi.


E dey rub my head with en left hand kon dey massage mi with en rite hand.


So I tell mysef, “I go get up go di town, enter di street kon follow korna-korna go find di pesin wey I love.” So I find evriwhere, but I nor still si am.


I look for Yu for nite, my spirit dey find Yu for morning, bikos wen Yu start to judge di world, den pipol for dis world go know and learn how to bihave well.


So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.


God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


From John di Baptist time kon rish naw, pipol dey struggol to enter God Kingdom, but na only doz wey dey struggol well-well, dey fit enter.


“Make una struggol well-well so dat una go fit pass di small door, bikos many pipol go try to enter God Kingdom, but dem nor go fit.


So na dis tins I dey struggol and work for akordin to en pawa wey dey work inside mi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ