My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.
(I dey tok with human being sense, bikos I know sey una dey weak.) Before, una dey give una body like slave to bad tins, but naw, una must use una full body take serve God, so dat una go dey do only wetin God wont.
My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.