10 Na swod go kill dem, den birds and oda animals go chop dia body.
Make una katch all di fox for us; especially di small-small ones, before dem go distroy awa vineyard.
But naw, make honga kill dia shidren and make dem die for war. Make di wimen luz dia husband and shidren; make diziz kill di men and make di yong men die for war.
“ ‘Na una bi di enemy wey dey worry and kill Israel pipol wen dem dey wahala and dat time na dia final ponishment for dia sin, dem dey face.
Gog, en sojas and all di pipol wey dey stay with am go die finish for Israel mountin and I go let bird and wiked animals chop dia body.
David still sey, “As God dey alive, na God go kill-am by ensef. One day e go sleep nor wake-up or dem go kill-am for war.