7 My viktory and honor dey kom from God. Na-im dey guide mi and na-im bi my Rock, so nobody fit kom attack mi for der.
Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever.
I don make God nomba one for evritin wey I dey do and bikos E dey for my rite side, I nor go shake or fear anytin.
Na God bi di rock wey dey protet mi. Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi and I dey save inside am.
God dey alive! So, make praiz bi my Rock own and I go bless my God wey save mi!
But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.
Na how long pipol go take dey tok bad about mi? How long una go dey tok wetin I nor do? How long una go kontinue to dey lie for my head?
Na God bi di strong place wey wi dey hide put and na-im dey help us wen wi dey trobol.
True-true, time dey kom wen pipol wey dey follow am well, go si en salvashon; den en glory go appear for di land again.
But na God bi di place where I hide put; na my God mi di mighty rock wey dey hide mi.
Kom make wi sing praiz God! Make wi shaut praiz di Rock wey dey save us.
Make wi always dey trust God and E go protet us forever.
na-im go dey save like kountry wey dem protet well-well. E go get food and wota to chop and drink.
Dem go bless and praiz Israel pipol, bikos of di Oga awa God.”
True-true, hills and mountins nor fit help us. But na only Yu wey bi awa Oga God, go fit help wi, yor pipol.
I nor go boast about anytin escept for di sofa wey awa Oga God Jesus Christ sofa and bikos of dat sofa, di world nor mean anytin to mi and I don die to di world too.