Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 62:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Dem dey spend all dia time dey plan how dem go take finish mi. Dem dey happy to lie about mi. Dem dey praiz mi for my present, but for dia heart, dem dey curse mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 62:4
27 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pipol wey dey lie and go against yor word, I hate dem well-well, bikos I love evritin wey Yu tok.


Make Yu nor drag mi follow pipol wey dey do wiked; doz wey dey tok like sey dem bi friend to dia neighbour, but dem dey plan bad tins for dem for dia mind.


bikos my enemies nor dey tok di trut. Wetin dey hongry dem to do, na to distroy odas; dia troat bi like open grave and na so-so lie-lie words full dia mout.


But even before dem born mi, Yu don plan betta tins for mi kon dey tish mi wisdom.


Yu like bad tins pass good ones and yu love lie-lie pass trut.


Dia words dey smooth like butter, but dia heart strong like stone. Dia word smooth well-well like pomade, but na dagger dey under dia tongue!


Doz wey dey fear God nor like lie; but na only shame and disgrace wiked pipol dey kause.


“Proud pipol; doz wey dey lie; doz wey dey kill innocent pipol;


So na dis sin go distroy una. Una go bi like high old wall wey don krack and wey go soon fall and na wons e go fall.


Di pipol dey deceive di king and en ofisas with all dia evil plans and di prince dem dey make di king happy with dia lie-lie words.


Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star.


Den di Farisee pipol komot go plan how dem go take katch Jesus with wetin e go tok.


For di same day, di Sadusi pipol (wey bilive sey resureshon nor dey), kom meet and ask Jesus,


For early morning, di priest oga dem and di eldas kon dey plan as dem go take kill Jesus.


But Jesus tell am, “Una wey bi Farisee pipol dey wosh outside cup and plate, but inside una belle, long-trot and wikedness full am.


Den di Farisee pipol and di law tishas kon dey wosh Jesus well-well. Dem send some pipol go pritend like sey dem dey follow Jesus, so dat dem go fit use en word against am, kon ripot am to di Roman Govnor.


Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.


Aldo dem know sey God law sey, pipol wey dey live like dat go die, yet dem nor only dey do dis tins, but dem even dey support pipol wey dey do am.


I dey like to obey God law with my whole mind,


Pipol wey dey do like dogs, doz wey dey do majik and kill odas; doz wey dey serve juju and dey like to lie, all of dem nor go enter di town.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ