Naw, una shance don kom. Make una remember sey God sey, ‘I go use David my savant take save Israel my pipol, from Filistia pipol and all dia oda enemies.’ ”
Dis na wetin God tok about lie-lie profets: “Dem don break my heart and all my body dey shake. I bi like pesin wey don drink wine well-well, bikos of di wey dem dey trit mi and my holy word.
Bet-Haram valley still dey join, plus Bet-Nimrah, Sukkot and Zafon go rish di rest side for Heshbon wey King Sihon dey rule; plus di aria for Jordan River east go rish di end for Kinneret Sea.
So dem selet Kedesh for Galilee wey dey Naftali kountry on-top di hill; Shekem wey dey Efraim kountry on-top di hill and Kiriat-Arba (wey bi Hebron) wey dey Judah kountry for hill.
Josef bone wey dem karry kom from Egypt, Israel pipol kon beri am for Shekem, for part of di field wey Jakob buy from Hamor sons (Na Hamor bi Shekem papa) and Jakob buy di field for one hundred silva koin.