Di pipol go dey waka anyhow for di land, dem nor go get hope and dem go dey hongry. So bikos of di honga and vexnashon, dem go look up kon curse dia king and God.
Dis na wetin God tok: “Una wey bi lie-lie profets dey make my pipol sin! If pesin give una food chop, una go sey make peace dey with am, but doz wey nor give una, una go won fight dem.
una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.