Make Yu nor kill dem just like dat, bikos my pipol go kwik forget di lesin. So, make Yu use yor pawa take make dem dey waka up-and-down without house, den make Yu honbol dem, bikos na Yu my God, dey protet mi.
Bikos di Pesin wey kreate una, go bi una husband. Na God wey get pawa bi en name. Israel God wey dey holy go save una. Dem dey koll am di God of di whole eart.
I go make sure sey Israel, my pipol know my holy name and I nor go let dem disgrace my name again. Den di pipol go know sey na mi bi di God wey dey holy.”
Dem go drive yu komot from where human being dey stay and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu and yu go sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like.