Una don make God taya with una many tok. But una still dey ask, “How wi take make God taya?” Na wen una sey, “Pipol wey dey do bad tins, dey good for Oga God eye and E like dem well-well and wen una still ask sey, ‘Where di God wey dey judge well?’ ”
But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.