So David tell all en ofisas wey dey with am for Jerusalem, “Make wi run at wons, so dat Absalom nor go kill us! Make una hurry or e go kom defeat and kill evribody for di town!”
I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.
David kon tink am sey, “One day Saul go kill mi. So, di best tin wey I go do naw, na to run go stay Filistia pipol land. Den Saul go stop to look for mi for evriwhere wey bi Israel own and I go free from en wahala.”