16 But I go koll my God and E go kon save mi.
I love dem, but dem dey try to distroy mi. Even doh I dey pray for dem, yet dem still dey lie for my head!
Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una, den una go give mi all di glory.”
But for mi, si as e good to dey near God! I don make di God wey get pawa my guide and I go tell evribody about di wonderful tins wey E don do.
Wen dem koll mi, I go ansa dem; I go dey with dem wen dem dey trobol. I go save and make pipol honor dem.
Dem and all wetin dem get enter groun alive, den di eart klose against dem. So dem die komot di kommunity.