Jonadab tell am, “Make yu do like sey yu nor well kon go liedan for bed. If yor papa kom si yu, den yu go tell am sey, ‘Abeg, make yu tell Tamar my sista sey make e kom give mi food. I wont make e make di food for here where I go dey si am, den serve mi by ensef.’ ”
Make yu nor hurry to make pesin leader and nor rush put hand for en head, so dat yu nor go karry anoda pesin sin for yor head. Make yu keep yorsef pure.
Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol.