19 but dem go die like doz wey don die before and dem nor go ever si day lite again.
But for yu, wen yu don old well-well, yu go die with peace of mind kon go join yor grand-grand papa dem.
King Baasha die and dem beri am for Tirzah. En pikin, Elah kon take-ova as king.
E dey save pesin life from deat and make am enjoy life again.
Yu don save mi from deat and Yu nor let mi fall at-all, so I go always dey serve Yu, as I dey enjoy dis life.
By den, yor body go-go back to groun where e from kom, while di spirit go-go back go meet God wey bin gi-am to yu.
Who go fit show sey, wen pesin die, en spirit dey go up, but wen animal die, na groun en spirit dey go?
“Den di king tell en savants, ‘Make una tie en hand and leg trow am outside for darkness, where e go kry and grind en tit.’
But dem go trow di pipol wey suppose enter di Kingdom for darkness, where dem go dey kry and grind dia tit.”
“But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’
Dem bi like wave for sea wey dey foam kom out. Dem bi like star wey nor dey stay one place and God don keep di place wey deep pass for darkness, dey wait dem.