Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 49:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Wi know sey even wise pipol must die; both fools and doz wey dey spiritual still dey die too and na odas go kollect evritin plus di money wey dem get.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 49:10
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My God, with di pawa wey dey yor hand, make Yu distroy pipol wey dey espect dia reward from dis world. But doz wey Yu like well-well, make Yu give dem enough and dia shidren go get plenty kon die leave propaty for dia shidren-shidren.


Wi bi like shadow wey dey waka pass and evritin wey wi dey busy dey work for, nor mean anytin. Wi dey gada money keep and wi nor know who go spend am.


Bikos wen dem die, dem nor go take anytin follow body. Dia money and evritin wey dem get, nor go follow dem enter grave.


I bin dey do like fool wey sturbon. I know sey for yor present, I bin look like animal wey nor get sense.


So my God, where all di good tins wey Yu bin do for us; di ones wey Yu do just as Yu promise David?


But una wey bi fool, make una tink again! Wen una go really get sense to undastand?


Wen God won judge yu, yor money and propaty nor go fit help yu, but na to obey God bi di only tin wey go fit save yor life.


Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom, but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.


Money na crown for wise pipol head; but foolish pipol work, dey only produce bad result.


“I dey foolish pass any oda man and I nor get sense like oda pipol.


God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.


Evribody for dis world na fool and dem nor get sense. Wetin dem fit learn from juju wey dem make from wood?


Pesin wey dey make money with wayo, bi like bird wey dey hash egg wey e nor lay. Wen e don dey old, e go luz all di money wey e get, den e go know sey e bi fool.”


“But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’


Bikos God sey, na only wons man go die and afta dat, judgement go kom,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ