Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 45:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Bikos una prince dey happy for una beauti. Make una honor am, bikos na-im bi una oga.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 45:11
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave. But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!


My God, yor throne go dey forever and ever. Na with royal pawa Yu take dey judge yor kingdom.


Kom! Make wi go woship and bow to am. Make wi knee down before God wey make us,


My woman! Di one wey fine pass among wimen! If yu dey find mi, make yu follow my animals footstep rish where I dey kon kare for yor small goats near di shepad tent.


Yu bi like dove wey hide inside rock, so make yu allow mi si yor fine face kon hear yor sweet vois.


Just as lily flower dey among shuku-shuku, na so my darlin bi among oda yong wimen.


My darlin, yu fine like Tirzah town. Yes! Yu fine like Jerusalem kon sweet like di great town.


Bikos di Pesin wey kreate una, go bi una husband. Na God wey get pawa bi en name. Israel God wey dey holy go save una. Dem dey koll am di God of di whole eart.


Di Oga yor God dey with yu and E dey always diliver yu. E dey happy well-well bikos of yu. En love nor go make yu fear again and E go dey sing sweet songs bikos of yu.’


So, dem woship am kon go back to Jerusalem dey happy well-well


Tomas ansa am, “O! My Oga God and my God.”


Una know di message wey E send to Israel pipol, wen E tok about di Good News wey dey give peace, thru Jesus Christ, di real Oga God.


Dis na bikos Christ die and e kom back to life, so dat e go bi Oga God to pipol wey don die and doz wey dey alive.


Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ