3 Dem nor win di land with dia swod and nor bi dia own strong hand make dem win, but na yor rite and strong hand with di shinin-shinin lite from yor face, help dem, bikos Yu love dem.
No kountry for dis world bi like Israel wey Yu komot from slave kon make dem yor pipol. Di big tins wey Yu do for dem, make pipol know yor name for di whole world. Yu save yor pipol from Egypt, plus di juju and gods wey dey der.
Make Yu use yor wonders take show mi yor love wey nor dey fail. Yu don save doz wey kom meet Yu for help. Yu save dem from dia enemies with yor mighty pawa.
Wetin make mi nor get hope? Wetin make my heart nor dey happy at-all? But I go still put my hope for God hand! I go still dey praiz am, bikos na-im bi my Savior and God!
But wetin make mi nor get mind? Wetin make my heart nor happy at-all? I go put my hope for God hand! I go praiz am again, bikos na-im bi my Savior and my God!
Joshua sey, “Na like dis una go take know sey, God wey nor dey die dey with una and E go really porshu Kanaan, Hit, Hiv, Periz, Girgash, Amor and Jebus pipol komot for una.