25 Wi don faint for groun kon sleep for dirty.
Why Yu dey hide from mi? Why Yu dey trit mi like sey I bi yor enemy?
My God, wetin make Yu stand far from mi? Wetin make Yu dey hide wen I dey trobol?
I liedan dey roll for dust; so make Yu save mi with yor word.
Na since wen I dey small Yu allow pipol dey opress mi and I don nearly die. Yu don ponish mi well-well and naw, na pains full my life.
But I go gi-am to pipol wey dey opress una; doz wey dey make una liedan for street kon waka on-top una like sey una bi dirty.”
Pipol wey dey chop betta food before, don turn who dey beg food for street. Pipol wey dey wear fine and betta klot before, don turn who dey wear rag naw.