24 Why Yu dey look di oda side? Wetin make Yu do like sey Yu nor know sey wi dey sofa and wiked pipol dey opress us?
Why Yu dey hide from mi? Why Yu dey trit mi like sey I bi yor enemy?
My God, wetin make Yu stand far from mi? Wetin make Yu dey hide wen I dey trobol?
Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us! E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do!”
My God, Yu go forget mi forever? Na how long Yu go trowey yor face from mi?
Make Yu raiz-up kom defend mi! My Oga God, make Yu take my matter like yor own.
I dey kry dey sey, “My God wey bi my rock, wetin make Yu forget mi? Wetin go make mi dey waka with pains bikos my enemies dey opress mi?”
Make Yu nor let dis wiked animal distroy yor pipol. Yor pipol wey dey sofa, make Yu nor forget dem forever.
Make Yu nor forget evritin wey yor enemies tok or how dem dey shaut anyhow.
Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.
God sey, “I go rijet dem, I go si wetin go happen to dem; bikos dis generashon dey show sey dem too know and dem nor get sense.