For dat day, God go use en great and pawaful swod take ponish and distroy Leviatan; dat dragon wey dey twist and waka fast-fast. Yes! God go kill di great monsta wey dey inside sea.
Di beast wey I si, bi like leopard, but en leg bi like bear leg and en mout bi like lion own. Di dragon kon gi-am pawa, en throne and strong authority to rule.
Den di fift angel pour wetin dey en basin put for di beast throne, at wons, darkness kover di beast kingdom and di pain kon dey make dem bite dia tongue.