17 Even doh all dis tins dey happen to us, wi neva forget Yu. Wi neva go against yor kovenant.
If wi don rijet awa Oga God kon dey pray to anoda god,
Dem turn back and dem nor kon get faith like dia papa and mama. Yu nor fit put hope on dem, bikos dem bi like bow wey don spoil.
So evry generashon go get hope and trust God and dem nor go forget en great mirakles, but dem go obey en kommand.
Wiked pipol go die enter grave. Dis na wetin go happen to all di pipol wey rijet God.
Israel pipol don forget di God wey save and protet dem like big rock. And naw, dem plant betta flowers and vines kon dey woship dem.
Yong woman dey forget to wear en gold ring? Abi woman wey won marry, dey forget to wear en marriage klot? But e don tey wey my pipol don forget mi.
E nor go bi like di old kovenant wey I make with dia grand-grand papa, wen I karry dem komot from Egypt. Even doh I bi like dia husband, dem nor gri keep di kovenant wey wi make.
God kon sey, “Na as I suppose trit yu, I go trit yu, bikos yu nor gri do wetin yu promise and yu break di kovenant.
Na mi, God dey kontrol una, so dat una go obey my kommand.
Yu dey ponish us just as dem rite am for Moses Law. But as Yu ponish us rish, wi still dey kommit sin and wi nor gri do wetin Yu tok.
so make una dey kareful, so dat una nor go forget God wey take una komot Egypt.
make una nor kon dey do like sey una too important, den forget di Oga una God wey bring una kom out from Egypt where una for bi slaves before.