Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 44:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Yu don make us di topik for dia joke; dem dey shake dia head for us like sey wi bi fools.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 44:14
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go remove una from Israel pipol and di land wey I give dem. I go still abandon dis temple wey I don make holy sey make dem for dey woship mi. Pipol for evriwhere go laf Israel pipol and dem nor go respet dem again.


And dis na wetin I tok about am: “ ‘ “Zion dota wey neva sleep with anybody before, dey curse and laf yu; Jerusalem dota dey shake head follow yu.


I go remove dem from my land wey I give dem; I go forget dis temple wey I santify with my present kon make pipol laf and fool dem among all di nashon.


Den I leta tell dem, “Make una si di kind trobol wey wi dey face, bikos Jerusalem don skata and en gates don distroy! Make wi ribuild di town wall, so dat shame go komot from awa eye.”


If na yu dey face wetin I dey face so; true-true, I go tok di same tin wey yu dey tok. I go shake my head kon tok against yu.


Naw, God don make pipol dey laf mi; dem dey kom spit for my face.


Pipol for evriwhere dey use mi make yeye; wen dem si mi, dem dey shake dia head dey laf.


My Oga God, make Yu sorry and pity for us, bikos wi too don get awa own share for di trobol.


Anybody wey si mi, dey laf mi. Dem go look mi kon shake dia head sey,


Awa neighbours dey laf us; pipol wey dey around us, dey take us make yeye.


“God sey, ‘Jerusalem town dey laf and play with King Sennakerib.


I go give dem wahala sotey all di nashons for di world go fear. Pipol go laf dem well-well; use dem dey make yeye kon dey curse dem for anywhere wey I skata dem go.


Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”


For di place where God go send una go, una go bi disgrace among di pipol for di eart.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ