13 Yu don let awa neighbours dey laf us. Pipol wey dey around dey take us make yeye.
Awa neighbours dey laf us; pipol wey dey around us, dey take us make yeye.
Yu don give oda pipol rizin to dey laf us and naw, awa enemies don take us dey do yeye.
Anybody wey dey pass, dey tif from am and en neighbours don take am dey do yeye.
Yor enemies dey laf and fool mi. Anywhere wey di king wey Yu anoint go, na so-so laf dem dey laf am.
God wey get pawa dey tell en pipol sey, “Wen una bi slave, dem nor pay any money take buy una, na so too, dem nor go pay anytin to take free una.
I go give dem wahala sotey all di nashons for di world go fear. Pipol go laf dem well-well; use dem dey make yeye kon dey curse dem for anywhere wey I skata dem go.
Moab pipol, hope una remember how una take laf Israel pipol? Una trit dem like sey dem bi tif.
For di place where God go send una go, una go bi disgrace among di pipol for di eart.