Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 44:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Na one-one kobo Yu sell yor special pipol and Yu nor gain anytin from inside.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 44:12
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dis na wetin God tok: “Una tink sey I drive my pipol komot like man wey drive en wife komot en house? Where di leta wey I take drive una mama? Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren? No! Una bi slave, bikos of una sins and dem karry una komot from una land, bikos of di bad-bad tins wey una do.


I go send enemies kom tif una propaty and dis go bi ponishment for di sins wey una kommit for di land.


I go make war happen to una and I go skata una go strenj land. Nobody go dey di land and I go distroy una towns.


How one pesin go fit porshu 1,000 among dem and two pipol porshu 10,000; if nor bi sey dia Rock sell dem and dia God give dem to dia enemies?


God go skata una among di pipol and una nor go many for di kountries wey God go drive una go.


Cinnamon, spices, incense, pomade wey dey send well, frankincense, wine, olive oil, flower wey dem take dey make bread, melu, sheep, shariot, slaves and human being soul.


Bikos of dis, God vex well-well for dem, so E let tif karry all wetin dem get. E allow dia enemies opress dem and dem nor fit protet demsef again.


So God vex well-well kon send dem go serve King Kushan-Rishataim for Aram Naharaim for eight years.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ