All di nashons bi like bird house for my hand and I gada dia propaty just as dem dey gada egg. Yes! No feada fit make mi fear and no bird fit open en mout sey e won bite mi!”
I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.
God go still allow una enemies beat una; una go attack dem from one side, but una go run komot seven side, den all pipol for di eart go dey fear bikos of wetin hapun to una.
For dat time, I go vex for dem well-well kon leave and hide my face from dem until dia enemies kill dem finish. Many wahala and trobol go ovakom dem and dem go sey, ‘Dis wahala don finish us, bikos God no dey with us again.’
Israel pipol nor fit stand for dia enemies front; dem run bikos disgrace don dey follow dem. I nor go dey with una again, unless una distroy wetin make dis wahala dey happen to una.
Di man ansa, “Israel pipol don run from Filistia pipol! Dem don kill di sojas well-well! Yor two boys, Hofni and Finehas, don die too. And dem don karry God Kovenant Box go!”